Nigeria 1-1 Tunisia: Iheanacho score and miss penalty for Super Eagles – BBC News Pidgin – BBC

Wia dis foto come from, @thenff
Di Super Eagles go jam Carthage Eagles for Austria on Tuesday
Kelechi Iheanacho score and miss penalty as Nigeria play 1-1 draw wit Tunisia for international friendly match wey dem play for Austria today.
Na Nigeria first score for di match and di Super Eagles bin get opportunity to double dia lead wen Tunisia goalkeeper Ben Mustapha fowl Ahmed inside di box.
Iheanacho step up to take penalty but miss.
But di lead no last long as Drajer Mohammed equalise for Tunisia before halftime to make am 1-1 for di Carthage Eagles afta bad defensive mistake from Super Eagles.
Nigeria struggle for di second half to break Tunisia down.
Before di game, Nigeria Football Association bin say all di Super Eagles players wey go play for di friendly match wit Tunisia test negative to Covid-19.
NFF announce am for dia official Twitter page. Di Super Eagles go jam di Carthage Eagles by 7.30pm West African time for Jacques Lemans Arena for Austria.
Tuesday friendly match, dey come days afta Nigeria lose 1-0 to di current African champions Algeria.
Di match kickoff by 7:30pm and dem show am live for SuperSport channel 204 and @AIT_Online .
Wia dis foto come from, @thenff
How to watch Nigeria Vs Tunisia international friendly match
Some football analyst bin expect few changes to di Super Eagles team wey lose to Algeria last week.
Nigeria cap four new players against di African champions, with di absence of dia main midfielders wey be Wilfred Ndidi, Joseph Ayodele-Aribo and Oghenekaro Etebo, as well as striker Victor Osimhen.
Coach Gernot Rohr tell im players say dem need to step up dia game to make Nigerians happy afta di defeat by Algeria.
"We must put up greater effort against di Tunisians. Na opportunity for some of di players to rise up to di occasion, stake a claim. Dem dey ready to go and I believe say we go see a much better game on Tuesday." Na wetin Rohr tok.
All 24 players for camp been take part for di Monday evening training session, and dem dey available for selection.
Goalkeepers Dele Alampasu and Matthew Yakubu, defenders Kenneth Omeruo, Chidozie Awaziem, Olaoluwa Aina and Jamilu Collins and forwards Cyril Dessers and Chidera Ejuke no play against Algeria and fit feature on Tuesday night.
Tunisia neva beat Nigeria for competitive game since di 2004 AFCON wey dem host, wen dem win di Super Eagles on penalty shoot-out afta both teams play 1-1 in regulation and extra time for di Stade Olympique for Rades, outside Tunis.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

SIMILAR POST:
Nigeria’s Super Eagles vs Ecuador friendly gets United States venue - Soccernet.ng

source

This post was originally published on June 11, 2022.

Visits: 3